Egypt vs Senegal highlights: Mo Salah Pharaohs loses match
Senegal beat Egypt 1-0 for di world cup qualifier play-off wey happun for Senegal.
E happun afta Mo Salah, pounce enta penalty area afta some slow Senegal defending. Although im effort hit di bar -e bounce down and onto di back of Senegal goalkeeper Saliou Ciss.
Senegal and Egypt bin participate for di last World Cup but none of dem qualify from di group stages for Russia.
Senegal dey aim for dia third appearance for World cup while Egypt dey chase dia fourth outing for di global showpiece, and second in a row for di first time.
Aliou Cisse bin keep majority of di players wey help Senegal win di Nations Cup for di first time ever as di Teranga Lions aim to qualify for consecutive World Cups afta 16-year absence wey end for 2018.
Egypt na im host di first leg, wit Senegal newly inaugurated Stade du Senegal wey go host di return fixture on Tuesday.
Egypt dey 34th on Fifa ranking.
Despite di disappointment say dem no win di African cup of Nations di Pharaohs still get better record.
For dia last six games before dis one, dem bin don win five and lose one – dat na di Afcon final match wit Senegal.
Dem bin get top players wey dem fit rely on to give dem victory for dis match but dia main player na Mohamed Salah.
Meanwhile, Senegal dey rank 18th for Fifa ranking.
Teranga Lions na current African champions afta dem win di Afcon 2021 wey Cameroon host.
Dem bin go into di game unbeaten for dia last thirteen games across all competitions, claiming ten wins and three draws.
Egypt vs Senegal Head to Head
Both teams bin don meet 14 times since 1987 vefore dis game.
7 March 1986: Egypt 0-1 Senegal -Afcon
2 August 1987: Egypt 1-0 Senegal – All-Africa Games
25 January 1997: Senegal 0-0 Egypt – Afcon qualifiers
13 July 1997: Egypt 2-0 Senegal – Afcon qualifiers
28 January 2000: Egypt 1-0 Senegal – Afcon
9 July 2000: Senegal 0-0 Egypt – World Cup qualifiers
20 January 2002: Egypt 0-1 Senegal – Africa Cup of Nations
10 October 2003: Egypt 1-0 Senegal – Friendly
29 December 2005: Egypt 4-2 Senegal – Friendly
7 February 2006: Egypt 2-1 Senegal – Afcon
5 September 2014: Senegal 2-0 Egypt – Afcon qualifiers
15 November 2014: Egypt 0-1 Senegal – Afcon qualifiers
6 February 2022: Egypt 0-0 Senegal (win by penalty) – Afcon
صفحتنا الرسمية فرندة – Farandh